
NEED A NEW JOB
Oruaro Egboje@egbojeoruaro412594
5 days ago
Headache oh😭😭😭. Everyday shouting KEEP QUIET but after two seconds noise continues
You sure say I fit still continue this work so😭😭😂😂
And month never even end sef😭😭
This is my third time teaching but this has to be the most stressful teaching Job I've ever had because na village area I dey so you know how those children go dey behave.
Wetin dey pain me pass be say the school management just dey find way to look for fault for my work so that Dem go deduct my money despite knowing how much I'm doing my best. My class is the most populated class in the school but yet she expects me to carry the same workload as others.
In case this work nor work out abeg🙏 people of God connect me to jobs, both remote and onsite 🌚
I can type really good
I can teach
and I can write really good essays stories and just anything that has to do with writing. Abeg nor be money I dey beg for na job opportunities cos I dey see am say this work I go leave am for the owner, her wahala too much😂😂.
Have you taught before, what was your experience like ?, How did you handle the management system when it felt suffocating and oppressing to you ?, did you still stay or leave ?
Tell us in the comments section cos me sef wan learn how una take handle the stress so that I'll know if I should stay or leave.
PS: This picture was taken the first day I started work
1 day ago