Edit Post
Marilyn Ossai@marilynossai697412
1 year ago
MERE MORTAL
Do you know who I am?
Na me you dey follow talk?
You know who I be?
You no dey look face nii?
E be like say dem no born you well
Something dey worry you for head?
Me and you no dey the same level oo
Na just one phone call go put you for your place
Your eye go clear now
E be like say you dey craze
Who are you?
Who you be gan gan
You identify as anything wey pass human?
I sabi who you be sha
Na you be the air wey we dey breathe
I don't forget, na you be giver of life
Abi no be so?
Ogbeni chill, make I reason you who you be
You be dust, you be sand, you be clay
Oga mi, you're just a MERE MORTAL, be humble.
Marilyn Ossai
#Poetry
picture credit:Diego Schtutman