Ibiang Ayei

Ibiang Ayei
@ayeiibiang080407

1 year ago

THE FLUX

It's satirical, the change we preach;
brooms sweeping real issues under the carpet
They say:
“Security is everyone's business",
but oga you too dey try to put eye for the market?
They say: “Justice Is Blind"
but justice still dey feel face before him use him matchet
E be like Justice dey fear face?
Cos e free rich man, put poor man pikin for casket

All man dey para!
Tempers flaring cos pump price dey high
Flood everywhere;
place wet, and yet our pockets dey dry
FG sef dey on defense, sake of say ASUU dey strike
Omor e choke everybody,
cos las las this government no try

It's so hard to survive
People be running two jobs just to save one life
Then imagine family man - 4 children and him 1 wife
To chop sef na problem,
cos 3-square meal don come dey hard like maths
We keep skipping meals like truants,
I swear, we no dey ever dey for class

Yes we're always in motion;
walking round the clock, we no dey get time sit
Cos if food no dey the table,
how family wan survive when dem no see chawn eat?
The hustle no easy,
if not wetin graduate sef go dey find for street?
True true this life no balance,
if not why we go dey try to make ends meet?



We're so sick and tired of this government,
e be like APC no dey cure again!?
We've gotten a taste of our own medicine,
so all of us just dey take this drug in vain
Family problem full our head, self-contain no fit contain us again
Naija don too put us for high tension, omor, nothing fit dey shock us again!

The street no safe again, your Gee fit use you
plus for G
Now e no hard to kill, bestie stab babe from
jealousy
Caught cruise until she caught feelings, wetin man
no go see?
Boys dey low-key baff soap to get money fly overseas

Controversy's become a venture, trolls be
dissing for fun
To have a bright future, people be throwing shades
at the sun
That's crazy ain't it?
Werey no dey weigh the pros and the cons
Be casting people with no concrete evidence of
their wrongs



Emotions be like jangolova, him mood dey on swing
Agbero to gent in 2 seconds, dey run both extremes
Bureau de change:
E no dey hard for us to change am for person,
Comrade and violence be like twins, this life don
teach am the lesson

This country is not for the weak, 7 days no fit dey
do us
Our energy dey on a high, clear eye no fit to dey
do work
So men dey pop on a steady, see guys don start to
dey do drugs
Everywhere hard for town, sotey married woman
sef dey hookup



Oppression yakpa for naija, all man dey fight for him freedom
But shebi who wan dey outstanding no suppose to dey sit down
Person wan use person gain person, snitches all about treason
Na who dey near dey fit to stab, but no one's
going to prison

Dem don cut long arms of the law, e no fit catch up with people
Robbers dey wakka as dem like, dey carry shoulder with ego
Nobody's “wanted" for their crimes, so men don
put head for evil
Senator switch to ruling party, so his sins are forgiven

There's no reverence left for the clergy,
shey na Spirit or trips?
Cardinals no dey give direction, congregation dey street
Who no wise no suppose wear thinking cap,
dey chop benefits
but “who-the-cap-fits" no wan wear the cap,
him fear politics

So we're throwing stones at your glass houses,
what have we got to lose?
Some men in uniforms and bulletproofs to cover the truth?
We buried the hatchet for so long, but you came with your brooms
This trend of holding umbrellas, sitting under leaking roofs




***






Written by: Ibiang, Ayei Okoi
Wednesday, 6th April, 2022.
10:50am
#Aï
#Nirclestories
#Poetry












65
1 year ago

Sign in to post a comment.


Sign In