Ibiang Ayei
@ayeiibiang080407
1 year ago
MENT
I see your projects have been executed senator:
70% embezzled funds
Squandered monetary allocations
20% on inferior building materials with no concrete evidence on documented expenditure
But still, you dey pose for picture,
make them for carry your image do billboard?
You see God!?
Abeghi!
Democracy in the mud!
You no dey see potholes wey be like grave for
our federal roads?
Dead bodies from accidents,
but still herdsmen just dey slaughter commuters
like goats
Big man wey dey sidon ontop poor man back still
put am one leg for throat
Kidnappers on rampage,
conveying victims on our waterways for boat!
Yet we talk say we get government!
E be like
una don high, ment or both!
Who do you take us for, ehn!?
Oh, so na because e go soon reach election,
na it make you turn-up for the trenches dey cunny smile like joker?
Make your propaganda for dey widespread
like pandemic, 5, 5K per voter?
People selling their futures on the cheap,
just see as
consciences dey flow anyhow for gutter
So how e wan better?
Ehn!?
You wey dey hope on promises like say dem
jazz you,
who commot your brain put mortar?
Who go stand up for you, your son and daughter
when e later choke, ehn!?
Na who go fetch una water?
...
***
Written by: Ibiang Ayei Okoi
Wednesday, 24th August, 2022.
7:39pm
#Aï
#A_Prequel
#S.O.T.N_(The_Warm-up)
#Nirclestories
#Poetry